Use am well-well di grace of God upon your life
Samson bin God nazirite wey God kreate separate to serve as a deliverer fo Israelites. But, he fail God and no fit deliva hin pipu from di philistines wey bi dea oppressors. Samson bin lost focus as di Israelite leader, he no lead a single national battle against di philistines but he fight some small-small wars against dem. On di oda hand, Samson dey padi-padi wit Philistine women and he refused to marry eni one from hin homeland. Hin passion and interest dey wit di philistines women,and he go only attack di philistines weneva dey won play with hin love life. Di philistines leader know say Samson get interest in dea women, and they talk say dem go use hin weakness catch am.
They call dea women make dem set trap fo Samson so dem go fit catch him and kill him. philistines use Samson wife(Delilah) who bi philistine to ask Samson di sekret of hin pawa. Di scripture talk say;
"Delilah kontinue to dey talk and komplain until Samson kon taya fo en wahala".(Judges 16:16) Samson fell fo her trick, he con tel her di sekret of hin strength, Samson con Delilah say“Dem neva kut my hair wons, bikos wen dem born mi, dem dedikate mi give God as Nazirite. So if you kut my hair, my pawa go leave mi and I go kon dey weak just like anybody.”(Judges 16:17) since Samson don tel hin sekret, di enemis no waste tym to shave hin hair, dey arrest am, komot hin two eyes and di rest bi history. Samson kon die fo di camp of hin enemis.
LESSON
Shidren of God must dey careful make dem no abuse di grace of God wey dey upon dea lives. Na di work of God to dey give us grace, but na our work to kip di grace wey he give us. we must to dey use God's grace di way it go fit dey glorify God. Punishment dey fo us if we no use God's grace and hin talents wel. So, all savants of God must dey careful to satisfy God in wetin dem dey do.
PRAYER
God abeg, no let m abuse your grace weh dey my life. help me make i dey fear and folow your instructions so i go fit prosper in life and ministry. I also pray say make you dey spoil all my enemis plan to spoil your grace fo my life. let my enemis fail, make i kon dey serve you well and make i receive your goodly reward fo this life and fo heaven also. Na fo oga Jesus krist name i beg all dis. Amen
